Wia dis foto come from, Twitter/Perrie
Dowen College student death don make Nigerians to react in different ways.
Sylvester Onoromi Jnr, one student of Dowen College Lekki, Lagos state Nigeria die under unclear circumstances wey police don begin investigate.
Dis na afta one Twitter user claim say "some students for di school injure and kill im cousin afta e no gree join cult."
But di Dowen College don come out tok for statement say di allegation no be true.
Dis mata don cause serious debate for Nigeria social media platform to di extend say #Justiceforsylvester don begin trend for twitter.
And Lagos State goment don order di indefinite closure of Dowen College until until di outcome of one investigation into di death of Sylvester Oromoni Jnr.
Former Nigeria vice president, Atiku Abubakar don join Nigerians to call for justice ova di death of 12-year-old Sylvester Oromoni.
Oga Atiku use im verified Twitter handle take chook mout for di mata and advise all concerned authorities to investigate tdi matter without fear or favour.
"We fail for our duties as parents/guardians, administrators, security agencies and goment if we no get to di bottom of di case of late Sylvester Oromoni, Atiku tok.
" E dey upon us to enthrone a safe environment for our schools. #Justiceforsylvester."
Wia dis foto come from, Twitter/Screenshot
Nigeria actress, Tonto Dikeh don dare to challenge di management of Dowen College ova di death of Sylvester Onoromi.
Tonto tok for one post inside her Instagram story say she dey coming for di school authority and add say she dey gada all di facts plus history of di misfortune
"Dear Dowen college, I don dey informed. I just dey gada all di facts and history of dis misfortune togeda then we go tok."
"No go anywhere. Our children no go go to school to be great and end up 6feet below. God forbid. Dat no be why we trust schools," di actress tok.
Wia dis foto come from, Twitter/Screenshot
Nigeria musician don still react to di news of Sylvester Onoromi death through im official instagram handle.
"No child should ever die in school. Especially not dis way," Burna boy tok.
Former Minister of Education and Oby Ezekwesili react say di news of di death of Sylvester Onoromi dey "too heart breaking."
"Too heartbreaking. Which word pesin fit even use to begin comfort di parents of #Justiceforsylvester. None really, except pray say our Lord hold dem for e arms with deep love. Kai."
Wetin goment and our society fit do to make sure say e gets justice even in death. #Justice," madam Oby Ezekwesili tok.
Wia dis foto come from, Twitter/Screenshot
Human rights' activist say closing down di Dowen College no dey enough.
"Closing di school no dey enough. We must all awaken on dead cases wey involve schools. We no fit send our children to school and dem return battered. #Enough."
Oga Harrison don first bin post say; "after Monday, no reopening go dey for di school. We dey relocate to Lagos."
Wia dis foto come from, Instagram
Actress, Mercy Johnson Okojie react say she neva dey able to watch di viral video of late Sylvester Onoromi before e die.
"I no fit bring myself to post di video, I no even dey able to watch am twice," di actress tok for her instagram account.
"I no fit imagine di pain dis pikin feel, I no fit imagine. Sylvester life cno fit dey in vain, e no fit go like dat."
Wia dis foto come from, Instagram
For her reaction Uche Jumbo say she dey wait for Dowen college to give Sylvester family a real explanation about wetin really happun to dia son.
Adesua Etomi-Wellington wey be Nigerian film actress, wonder weda Dowen college no go give Sylvester family a real explanation about wetin happun to dia son?
Adesua say she no wan to hear any football story ontop di mata.
Popular Comedian, Freedom Atsepoyi Aka Mr Jollof react by calling of Delta state goment to take action on di mata.
Mr Jollof wey do vidoe and post am for e instagram handle say Sylvester Oromoni Jnr na pikin of Delta state so make di govnor, Senator Ifeanyi Okowa help find justice for di mata.
"Governor Okowa na our Pikin die for @dowencollegelagos use your might to get justice for our son #justiceforslyvester."
Wia dis foto come from, Instagram
Former BBNaija star Tacha also join di call for justice say e take a village to raise a child.
Tacha add say "SYLVESTER is everyone pikin. We no go stop talking!! JUSTICE MUST BE SERVED!!! #Justiceforsylvester" di Nigerian celeb write for her social media page.
Mercy Eke, anoda BBNaija celeb tok say she still in shock after watching di Dowen College Student Death video.
"No child gatz to ever go through dat type of excruciating pain in di hands of anybody." She tok.
Oda Nigerians don also react as well for twitter and oda social media platforms.
Wia dis foto come from, Twitter/Screenshot
Wia dis foto come from, Twitter/Screenshot
Wia dis foto come from, Odas
Wia dis foto come from, Dowen college
Lagos State Goment don order di indefinite closure of Dowen College, Lekki.
Di State Ministry of Education confam di close down of di boarding school on Friday.
Di closure go continue until di outcome of one investigation into di death of Sylvester Oromoni Jnr, one student of di educational institution.
Lagos Commissioner for Education announce di closure inside statement after one meeting with di School Management and Staff.
© 2022 BBC. De external site no concern BBC. De way wey we de take go external link.